Zimbabwe vs Nigeria Live Score 19 Nov 2023

Zimbabwe vs Nigeria match preview, team news, head to head, kick-off time

Zimbabwe is going head to head with Nigeria starting on 19 Nov 2023 at 13:00 UTC . The match is a part of the FIFA World Cup, Qualification CAF, Group C.

Currently, Zimbabwe rank 4th, while Nigeria hold 2nd position. Looking to compare the best-rated player on both teams ‘s rating system assigns each player a specific rating based on numerous data factors.

On livescore you can find all previous Zimbabwe vs Nigeria results sorted by their H2H matches. also provides the best way to follow the live score of this game with various sports features. Therefore, you can:

Nigeria go meet Zimbabwe as di Super Eagles hope to redeem diasef afta dia uninspiring 1-1 draw against Lesotho on Thursday for di 2026 World Cup qualifier.

Di first match for Nigeria bin shele for dia homesoil for Godswill Akpabio Stadium for Uyo, di Akwa Ibom State capital but di result rubbish di many predictions ahead of di match against Lesotho.

Di Super Eagles bin lose many chances wey dem suppose utilise to coast home to victory on Thursday, and all eyes dey on dem now as pipo dey watch if dem go fit change dia fortune wen dem meet Zimbabwe for Rwanda Southern Province of Butare by 2pm Nigerian time today.

Wetin fit ginger Zimbabwe for today match na how Lesotho bin stand gidigba against Nigeria and dia own performance against Rwanda on di same day.

Although Zimbabwe match against Rwanda for Stade Huye on Thursday bin end for 0-0 but dem display correct energy, only be say dem dey unlucky not to score.

Na di same Stade Huye Zimbabwe adopt as dia home ground for di match against di former African champion and na only time go tell which team go sing di song of victory.

Zimbabwe vs Nigeria head to head

Nigeria win four of dia last seven meetings wit Zimbabwe and draw two.

Dia only loss na for one international friendly for August 1981.

Nigeria team news

For dia first match, di Super Eagles bin miss di ogbonge Napoli striker Victor Osimhen sake of injury, and today dem go miss anoda ogbonge striker Taiwo Awoniyi for di same reason.

Awoniyi no travel wit im colleagues sake of injury and im don return to England where Nottingham Forest doctors go try dia best to ensure say e get back in shape on time.

Na Awoniyi and Victor Boniface bin lead di Super Eagles attack against Lesotho but Coach Jose Peseiro go make changes sake of Awoniyi absence today.

Today match dey raise question about di future of Peseiro wit di Super Eagles as speculation dey fly around say di Nigeria Football Federation fit sack am if Super Eagles lose to Zimbabwe today.

However, di 63-year-old Portuguese go need prove imsef today.

Zimbabwe team news

Zimbabwe coach Baltemar Brito go wan make im players maintain di same energy against Rwanda wit Nigeria today but dis time around dem go wan ensure say dia chances result in goals.

Di Warriors bin set up 3-5-2 formation and dem give Rwanda a run for dia money on Thursday.

Brito tok say pipo go expect revenge from Nigeria sake of say dem draw dia first game against Lesotho but warn say di West African kontri no dey play against small or weak nation today.

“Dem go come strong, but we go come strong too. We dey here to face dem,” Brito tok.

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*